VeryDarkMan’s Drama with Dammy Krane: Money, Proof, and a Call-Out



VeryDarkMan calling out Dammy Krane for lacking proof against Davido.
courtesy of VeryDarkMan’s Instagram

Abeg, una don see VeryDarkMan’s latest story? Baba no dey joke o! 😅 Man legit carried money go give "Dammy Krane" to help him feed himself. Yeah, "feed himself" Now, that’s what I call true brotherly love… well, sort of. 🫣

VeryDarkMan come dey talk say he wan help Dammy fight Davido, but only on one condition  "proof". No be all this mouth wey no get receipts o! Man say, "If you no get proof, no bring am come here. We no fit just dey talk anyhow!" 🔥

But here’s where e sweet pass, Dammy come dey behave somehow. You know that kind way wey person dey act like everything dey okay, but in reality, things just dey scatter behind the scenes? 😂 Dammy was calling VeryDarkMan “my baby” and everything, hug am like say na him long-lost bestie. 🤦🏽‍♂️ And our guy just dey look am like, “Omo, calm down. This no be love story. Bring the facts!” 🤣🤣🤣

Sha, the "police men" self enter the gist. They collect three bundles of cash and still leave one. Na wah o, big man things. 🤑 VeryDarkMan tell Dammy say make e calm down and face reality🤣🤣, but e no wan hear. All this while, Dammy dey use Davido name anyhow, forgetting say if he no get solid evidence, e fit just dey talk to the wind.

But here’s the message sha: If you no get "proof", no go dey drag people’s name for mud. All this talk wey no get leg fit land you where you no expect. 🚫 If you go drag someone, at least hold solid ground!

At the end of the day, VeryDarkMan dey para for Dammy Krane say, “Why you no leverage your old friendship with "Davido"? You for just make music together instead of causing all this unnecessary wahala.” 😒

And for those wey dey always drag people for "clout" without proof, VeryDarkMan don drop wisdom: "Get your facts straight or keep quiet." Otherwise, you'll just be shouting into thin air. 🙄


Post a Comment

Please Select Embedded Mode To Show The Comment System.*

Previous Post Next Post