![]() |
VeryDarkMan |
Why? Na wetin we dey find sef? You fine, you still wan add extra to wetin God don bless you with? Na the same peer pressure and social media illusion dey push plenty people into this corner. VeryDarkMan even talk say e get woman wey do am before, she come out like say she carry TV for yansh! Imagine person backside resemble old box TV from back in the day, 14 inches TV to be precise. 📺🤣 What are we really looking for? Wetin this social media pressure dey do for una?
Some babes dey come rub cream, steam themselves, even marinate themselves like chicken for pot! Dem dey turn skin to wetin e no suppose be, just because everybody wan shine for Instagram. 🌶🍗 But make we reason this thing well well, e really worth am? People dey pay huge amounts, enter surgery room, but few dey waka commot alive. Na the successful stories una dey see, but nobody dey really talk about the ones wey no make am.
And see eh, this no be the first time wey person go hear story like this. Dem go enter surgery room, and na there e go end. For wetin? Small nash? Ladies, make una no let peer pressure confuse una. Big nash no be ticket to heaven. 😂 If your mama fit marry with flat yansh (like VeryDarkMan mama), abeg, who you dey compete with? 😆
"Women wey sabi no dey do pass themselves." If gym no fit give you the shape you want, abeg, carry yourself the way you dey. You fine just the way you are. Na real wahala dey follow this surgery thing, and e no worth the risk.
So, make we calm down. If God no give you nash, no be end of life. If man no like you because of nash, my sister, find another one – simple as ABC. 😌 Peace and love, my people! No go do pass yourself o. When you play with fire, you fit learn the hard way. 🔥✌🏾